Twitter pick Ghana as first Africa office - See wetin to know

Ghana / Jack Dorsey

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 2 mins

US-based social media company Twitter don choose Ghana as di location of dia new office - di first wey dem go get ontop di continent. But wetin make dem choose Ghana?

On Monday, Jack Dorsey tweet: "Twitter don land di continent. Thank you Ghana and @NAkufoAddo", to announce di first company office wey dem go set up Africa.

De fact say di oga patapata of Twitter, wey bin visit Ghana for November 2019, thank president Nana Akufo Addo, show say dis na arrangement wey go get Ghana goment backing.

Na also during di period of di Ghana visit na im Dorsey - wey bin dey do tour of African countries den - tweet im desire to come live on di continent for "3-6 months mid 2020" but say im no sure wia.

But now e be like say im don make im decision, wit di announcement of Twitter new office.

Di opportunity for Dorsey to live, share and contribute directly to Africa tech community, even if na from Ghana, na one wey many pipo for di industry no go joke with.

From dia vacancy page, we torchlight say na nine positions dem dey find staff for. Visit dia website for more informate.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

De announcement receive chaw reactions including one from Ghanaian leader, Nana Akufo-Addo who describe de move as "excellent."He tweet, "de choice of Ghana as HQ for Twitter Africa operations be EXCELLENT news. Gov't den Ghanaians welcome very dis announcement and de confidence dem get in our country"

Why Twitter choose Ghana?

E fit be because of how Ghana dey support business.

World Bank say di ease of doing business for Ghana na 118, according to data wey dem release for 2019. Compare dis to di rank of 131 wey dia neighbour kontri Nigeria get.

To avoid confusion, di rank of 1 mean say e dey easy to do business for that kontri. So in dis case Nigeria worse pass Ghana.

But according to di social media giant, dem choose to put office for Ghana because na kontri wey dey do well for democracy and also support "free speech, online freedom, and di open Internet, wey Twitter na advocate for."

E no dey clear if Twitter consider recent record of Ghana ontop mata wey relate to LGBTQI+, wey some pipo go say get small k-leg.

Twitter also list dis oda reasons like how Ghana go host di Secretariat of di African Continental Free Trade Area.

De social media giant get 32 offices for 19 countries.

Social media reactions to de news

Ghanaians on social media dey create humour around de decision of Twitter to set up Headquarters of Africa operations for de country.Moments after de announcement by Jack Dorsey, dem take to same Twitter to declare say de reason for de move be sake of Ghana get better jollof pass some people.More people make excited over de news, most people believe say dis be solid opportunity for de country in de tech space.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2