Rocky Balboa: Sylvester Stallone no go show for Creed III

Sylvester Stallone

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 1 mins

American actor, Sylvester Stallone don remove di Rocky Balboa boxing gloves as im rep report say im no go come back for di part three off Creed.

Tori be say im bin answer pesin comment on weda dem go be Creed III and im answer say "E go dey but I no go dey inside. Keep Punching."

Stallone bin act for di last two Creed wey be di continuation to di Rocky movies wey don dey four parts.

But for di Creed movies, di character Rocky Balboa no come to box but as trainer to Adonis Creed, wey dey acted by Michael B. Jordan.

Creed III go comot for Nov 23, 2022 and e go be di first time wey Michael B. Jordan go direct feem.

But dat one no mean say e don comot totally from di Rocky Universe as im announce say im don finsh im own directors' cut of di 1985 Rocky IV on top say complete am as im bin like.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Sylvester Stallone don act for plenti action feem across im career most notably na di Rocky movies and di Rambo movies as well as di Expendables.