Derrick Jaxn wife: Who is Derrick Jaxn, im net worth and family?

Wia dis foto come from, Getty Images
Derrick Jaxn na social media personality wey dey call im self, Self-Love Ambassador.
E get ova 700,000 subscribers for Youtube wey im don dey post content for di past seven years.
E also get 1.3 million followers for Instagram.
Derrick Jaxn bin marry im wife Da'Naia for January 15, 2018 and dem get two pikin.
Wetin im dey do?
Oga Jaxn na online relationship expert.
E start im business of "self-love" for 2012 wia im bin dey tell pipo dem about wetin dem suppose know about relationship mata.
Im don chook im mouth for inside some of di most interesting relationship mata of famous pipo. Pipo like, actor Michael B. Jordan and Lori Harvey; TI & Tiny and rapper Future palava dem among plenti more.

Wia dis foto come from, Instagram/@derrickjaxn
Di 31 year old don write seven books about relationship and na di CEO of one couple game wey im call "Mentally Stimulate Me Card Game".
End of Di one wey oda users dey read well well
E say for im website say di game na to "solve di wahala of tok-tok wey suppose happun for di house of im fans dem."
How much be Derrick Jaxn net worth?
Tori from Biography mask tok say im fit dey make reach $134,500 every year.
Dis no goinclude im money im dey make from im card business or di ten books wey im don write wey include fictional book "A Cheating Man's Heart" Part 1-3 and "Heal Together without Hurting Each Other".
E also dey go on speaking events wey im dey speak on relationship mata as well as Meet and Greet with im fans dem.
Who Be Da'Naia Jackson?
Da'Naia Jackson na Derrick Jaxn wife of three years, togeda dem get 2 pikin dem.
She bin graduate from di Tuskegee University with Marketing Degree for 2011.
Tori be say di 30 year old be business woman.
Before her wedding she bin lose 34 kg afta tori say she bin suffer post-partum depression for di birth of her first daughter.












