Attack on governor of Benue State: President Muhammadu Buhari say attack on Governor Ortom 'unacceptable'

Wia dis foto come from, Nigeria Prsidency
Nigeria president Muhammadu Buhari don condemn di attack on Governor Samuel Ortom of Benue State.
Di president for inside statement say "di string of brutal attacks on individuals and communities for di state, wit di latest one wey target di govnor, dey "unacceptable"
President Buhari call for open "open and transparent investigattion" of di said attack.
On Saturday, Governor Samuel Ortom of di central Nigerian state of Benue bin tok say unknown gunmen wey reach about fifteen all dressed in black bin dey shoot directly at him and e security men.
Im allege say di attack bin dey planned to "eliminate am, as im run for about two kilometers."
Di incident according to di govnor happun along Makurdi/Gboko road for Makurdi Local Government Area of di state.
Reactions to attack on Ortom
Anoda sitting Govnor, Nyesom Wike of Rivers, say di federal goment go dey responsible if anyone assassinate Ortom; E add say dat kain incident go even cause anoda civil war for Nigeria.
Attacks on govnors no common for Nigeria but e dey happen, especially for northern region of di kontri, allegedly by Islamic militants.
End of Di one wey oda users dey read well well
For September 2020, one group ambush di convoy of Borno state Govnor Babagana Zulum for road, and for di attack 14 police officers and soldiers and four civilians die. Although di govnor imsef survive.
But till today authorities never catch those behind am.
Di IGP order di immediate deployment of specialized investigators from di Force Criminal Investigations Department for Abuja, to go support police for Benue, in di hope say dem go track down and arrest di criminals of Saturday gunfire attack.












