Fuel Price in Nigeria: N212 petrol price trend afta PPPRA and NNPC statement on hike - See wetin you suppose know

Wia dis foto come from, AFP
Fuel price hike, Fuel price increase, NNPC, PPPRA na im dey trend for Nigeria social media even though Nigerian National Petroleum Corporation don insist say dem no increase price of petrol dis Month.
NNPC clarify dis mata today through one post for dia official Twitter handle afta di Petroleum Products Pricing Regulatory Agency (PPPRA) bin publish one new petrol pricing template for dia website on Thursday.
According to di template wey PPPR bin upload, di landing cost of petrol na N189.61 while di recommend selling price dey between N209.61 and N212.61 per litre.

Wia dis foto come from, PPPRA
Immediately afta dat post, Nigerians begin react with shock, but PPPRA don delete di petrol pricing template wey dem bin post for dia website.

Wia dis foto come from, PPPRA
As dat one dey happun, di Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC) later clear di air say 'no Increase in Ex-Depot Price of PMS in March.'

Wia dis foto come from, Twitter
Also, Minister of State for Petroleum, Timipre Sylva, don apologise give Nigerians for di stress and inconvenience wey di misinformation about di increase of fuel price cause dem.
Oga Sylva explain for one statement wey e bring out today, say neither im or President Muhammadu Buhari give approval for di increase of price of petrol to N212 per litre.
E add say di informate na complete lie no mata di source e come from;
End of Di one wey oda users dey read well well
"I want to assure you dat di informate dey completely untrue."

Wia dis foto come from, Getty Images
For February 2021, NNPC bin promise say petrol price go remain di same for di month of March to allow smooth negotiations between di goment and labour unions.
Nigeria presently dey operate on price modulation system for petro mata- dat na di system wia di retail price of petrol dey fixed to according to wetin dey happun for di global market.











