Congo gold mountain: See wetin we know about di viral video

Gold mine for DR Congo

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 2 mins

Di goment of DR Congo don send Police to 'secure' di area wia one video show say villagers dey pack awoof gold comot from.

So, wia di 'gold mountain' dey?

BBC associate tori pesin inside Democratic Republic of Congo Byode Malenga, torchlight say di mountain dey Birava village, 35km from di north of Bukavu, inside di capital city of South-Kivu province.

Di latest now say goment don send Police to di area to return order and to collect back di gold wey di villagers bin don carry.

DR Congo na kontri wey dey rich in minerals and precious metals like gold, and di mountain inside di video na registered mining area wey get official workers.

No be all di pipo we see for di video be di actual workers on di site, Malenga bin tok.

Although di video begin spread for social media on Tuesday, Malenga say di incident happun over di weekend on Saturday.

Tori be say di mountain get 60% to 90% of gold.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Wetin di video show?

For wetin be like awoof, free-for-all, di 30 seconds video show plenty villagers ontop one mountain, dey pack small small gold from di ground. For anoda part of di video we see some pipo dey wash gold comot di red sand wey follow am come.

Di pipo on di mountain reach hundreds.

DR Congo 'gold' conflict

Di Human Rights Watch say gold na one of di biggest resource wey Congo get but when only few pipo begin make di money for demself, others feel say e no balance that way.

Dis one form di rise of militia groups wey bin wan control major areas wia gold dey and na also di cause of major katakata and fight-fight among pipo dia.

Quick facts about gold

  • Gold na di most popular precious metal in di world
  • To buy 1kg for world market, you go need hold about $1720 (as at di time of dis tori)
  • Pure gold na 24 karat, 18-karat get 75 percent pure gold, 14-karat gold get 58.5 percent pure gold, and 10-karat gold get 41.7 percent pure gold
  • Since ancient times, na im pipo don buy gold as investment