Covid-19 vaccine in Nigeria: Goment launch website for coronavirus vaccination registration - See wetin you need to know

Wia dis foto come from, Reuters
Nigeria goment don launch website to register Nigerians for coronavirus vaccination.
Di National Primary Health Care Development Agency (NPHCDA), announce dis informate for Twitter handle on Monday.
Di agency for dia website release guidelines on how to register for Covid- 19 vaccination for Nigeria.
Dis development dey come as Nigeria dey prepare to receive di first batch of di Covax AstraZeneca vaccine on Tuesday, 2 March.
Di agency boss Faisal Shuaib say dem don also launch di TEACH strategy for COVID-19 Vaccination and Electronic Management of Immunization Data (EMID) to assure Nigerians of dia readiness to roll out di COVID-19 vaccination campaign smoothly."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Wetin be di T.E.A.C.H strategy
"T.E.A.C.H na acronym for di 5-point strategy wey di vaccination implementing arm of di Federal Ministry of Health & the NPHCDA develop from dia many years of vaccination Implementation experience for Nigeria.
"T: Traditional Vaccination Campaign Approach;
E: Electronic Self-Registration by Eligible Nigerians;
End of Di one wey oda users dey read well well
A: Assisted Electronic Registration of Eligible Nigerians;
C: Concomitant Vaccination alongside Electronic Registration
H: House-to-House Electronic Registration"
Di goal na to introduce COVID-19 vaccine in a phased and equitable manner, based on di advice of di WHO.
Who go first collect di vaccine

Wia dis foto come from, PFIZER
Di National Primary Health Care Development Agency (NPHCDA) say for di first phase of di vaccination wey dem go carry out, di following group na im dem go give priority.
- Healthcare workers
- Front line workers - di Military, Police, Oil and Gas workers, Nigerians wey dey Border Posts
- and Strategic Leaders
Nigeria dey expect to receive 3.92 million doses of di AstraZeneca vaccine from di Covax facility.
Di vaccines ago comot from India on 1st March 2021 and arrive Abuja at 11 am on 2nd March 2021.
Wetin you need know about di vaccine

Wia dis foto come from, Getty Images
Twenty-four African kontris go soon collect di Covid-19 vaccines from di UN-backed Covax programme.
Dem include Kenya and Nigeria wey go collect di vaccines on Tuesday.
Kenya go get 1.25 million doses of di AstraZeneca/Oxford vaccine and vaccinations dey expected to start immediately, according to Health Minister Mutahi Kagwe.
Frontline health workers and old pipo na dem go receive di vaccine first.
Nigeria go receive 3.92m vaccine doses, e go become di third West-African kontri to benefit from di facility afta Ghana, and Cote d'Ivoire.
Di kontri dey expect to receive a total of 16m doses from Covax in di next few months.
Ivory Coast on Monday become di first kontri to begin rollout vaccines from di covax programme.
Wetin be Covax?
Di World Health Organization, di Gavi vaccines alliance and di Coalition for Epidemic Preparedness Innovations (CEPI) na dem set up di Covax scheme to epp poor kontris, make rich kontris no push dem go back for di distribution of di Covid- 19 vaccine.
Di Covax scheme purpose na to reduce di gap between rich kontris and poor kontris wey no go fit buy di doses. Dem design di programme so dat rich kontris wey dey buy di vaccines go agree to buy for poor kontris too.
Di programme hope to deliver more dan two billion doses to pipo for 190 kontris in less dan a year. Dem wan make sure say 92 poor kontris go get access to di vaccines di same time 98 rich kontris go also get dia own.
E dey aim to reach up to 20% of di populations of poor kontris and e go be free as dia goments no go pay any money for am.














