DaBaby Jojo Siwa: American rapper Jonathan L. Kirk "Beatbox freestyle" call Nickoledeon Star Jojo Siwa N-word

Wia dis foto come from, Dababy Twitter
Jojo Siwa na 17 year old Nickoledeon Star with multi-million dollar hairbow business and Jonathan Lyndale Kirk AKA DaBaby na very popular rapper, so wetin connect di two?
Na wetin plenti pipo start to dey ask dem self afta di rapper release "Beatbox freestyle" on Friday.
And mostly because e just comot from no where, unprovoked.
Dababy say "N-word, you a bitch, Jojo Sinwa, bitch". even hold her picture for di video.
Twitter para no be small on top di mata with some pipo yabbing dia height difference, while odas decide to enta how she get money pass am.

Wia dis foto come from, Twitter

Wia dis foto come from, Twitter
But DaBaby comot to explain di mata afta di whole of Twitter para.
For tweet im say, im add di Youtuber name inside im freestyle because im three year old pikin sotay im don spend im money buy every product Jojo bring come outside.
Im come add say no be beef, na just word play wey di internet no quick understand.
End of Di one wey oda users dey read well well
E further add some bars, wey e use her name tok for Twitter say "I don't Siwa they so mad."
Meanwhile since di gbege start, di former "Dance Mom" star neva comot to say anything.
Dis na as di 17 year old don dey get several bashing from different sources since she comot as part of di LGBTQ for January.
How much money Jojo Siwa and DaBaby dey make?

Wia dis foto come from, Getty Images
[Jojo Siwa net worth] - While we neva know plenti tins on top di money wey she dey make on top say you go need to comot how much she dey pay suppliers, taxes and oda costs wey dey come ith her business, Jojo Siwa bin reveal say for 2018 alone she sell pass 40 million bows world wide wey fit make average of 400 million dollars.
And she get oda tins wey she dey sell.
Dis one no add di money she dey make from her movie, music and YouTube career wey boast of more than 12 million subscribers.
As well as the TV cartoon wey she dey do with Nickelodeon.
And money wey comot from concerts wey she do for 2020 alone.
Many Sources tok say her net worth fit dey around 14 million dollars.
[DaBaby net worth] - On di oda hand, many sources put DaBaby at three million dollars with im source of income as rapping, song writing, performance and streaming money.
Im bin reveal for one sonfg, "More Mone, More Problems", say im get $300,000 to perform for show during Covid-19.
Tori be say , before di pandemic hit, im bin dey make $124,000 per month but nobodi really know im deal with Interscope Records wey im sign with as di details of im contract dey private.











