Court sentence Sodienye Mbatumukeke to death for killing Jumia delivery agent Chukwuma Eleje for Port Harcourt

Jumia delivery agent

Chigozie Igwe of di Rivers State High Court don find Sodienye Mbatumukeke guilty of di murder of Chukwuma Eleje, one Jumia delivery agent.

Justice Chigozie Igwe also find Mbatumukeke guilty of armed robbery.

Di accused pesins Sodienye Mbatumukeke and Excel Naabee bin dey stand trial for two count charges of di murder of Chukwuma Eleje and armed robbery.

But Justice Igwe discharge and acquit di second defendant Excel Naabee of all di charges.

Jumia delivery guy

Justice Igwe also sentence Sodienye Mbatumukeke to death by hanging till im die for di murder.

Jumia delivery guy
Wetin we call dis foto, Di convict Sodienye Mbatumukeke aftacourt sentence am to death by hanging

Remember say dem kill Chukwuma for March 2017, wen im go deliver items wey one online buyer bin order but later, Police recover im dead body inside septic tank (suckaway).