Lekki Toll Gate Lagos Nigeria today protest update: Rinu Oduala, EndSARS activist pull out of Lagos Judicial Panel wit 'no hope for justice' as February 13 protesters plan demonstration

Lekki Toll Gate Lagos Judicial Panel [Nigeria EndSARS protest]: Rinu Oduala

Wia dis foto come from, Twitter/Rinu

    • Author, Princess Igho Williams
    • Role, Broadcast Journalist, BBC News Pidgin

Rinuola Oduala, one of di youth representatives for di Lagos Judicial Panel on Restitution for victims of police brutality don wash her hand comot from di panel.

Rinu post for her twitter handle say she dey comot hand from di panel sake of say she no see di kind justice she dey hope for.

" I dey step down from di Lagos Judicial Panel as e now dey obvious say di goment dey only out to use us for performative actions."

22 years old Rinu decision dey come as some Nigerians wey dey vex dey plan to protest go di Lekki Toll Gate inside Lagos tomorrow afta di Lagos Judicial Panel take decision to give back di toll gate to di owners, Lekki Concession Company [LCC].

Lekki Toll Gate Lagos Judicial Panel [Nigeria EndSARS protest]: Rinu Oduala

Wia dis foto come from, Rinu Oduala

Wetin we call dis foto, Rinu Oduala is on the panel of a judicial inquiry in Lagos looking into police abuse

"We must not forget di purpose of dis panel: to address injustice and create accountability for di SARS brutality and for di terrible events on 20th October 2020." Rinu tok

"Wen calls for justice dey covered by commercial concerns and vested interests, dis go make pipo dey question di legitimacy and integrity of di entire affair and di impartiality of di proceedings. Without a final panel report or actionable steps, we are returning to the status quo.

"My stand on di reopening on di toll gate is clear; di state goment and di private organisation operating di toll neva dey cleared of collusion with elements allegedly deployed by di federal goment to target citizens on home soil during a time of peace, without provocation."

She conclude say partial win no dey enough and she go continue to hold di goment di goment accountable and she hope to spend di next few months reconnecting with victims of police brutality affect and document dia stories.

Rinu Oduala announce her decision to pull out of Lagos Judical Panel on di night before di February 13 protest wey groups dey plan to occupy Lekki Toll gate.

Tori be say those wey no happy wit di Lagos Judicial Panel latest ruling wan use demonstrations wey go use hash tags like: [#OcuppyLekkitollgate] [#DefendLagos] and [#DemNoBornDemWell] to protest di authorities decision to return di toll plaza back to di company wey dey operate am - Lekki Construction Company.

[Lagos Judicial Panel] - How di panel provoke Rinu Oduala to pull out

Lekki Concession Company request wey panel hearing approve on 6 February ontop Lagos Lekki toll gate plaza mata fit be di main reason wey provoke Rinu Oduala, one of di only two youths representatives for di panel to pull out.

Tori be say Justice Okuwobi wey bin di chairman of di panel sit with four oda members of di panel to listen to arguments for and against di application wey lawyer to LCC Ltd, Demola Seriki bring come for di re-opening of dia facility.

Dis na di number 4th time di Lekki Concession Company [LCC] dey make dis application for reopening of di toll gate.

Lekki Toll Gate Lagos Judicial Panel [Nigeria EndSARS protest]: Rinu Oduala

Wia dis foto come from, Getty Images

LCC lawyer argue and ask di panel to allow di company take possession of di toll gate plaza for di purpose of torch-lighting di damages so dat dem go fit make insurance claims wey di company need to fit repairs di toll gate and e say dis go last about two months.

Di oda four members wey sit with Justice Okuwobi to hear LCC application na; Segun Awosanya (AKA Segalink), Oluwatoyin Odusanya (wey be Director, Citizen's Right), DIG Taiwo Lakanu ( wey dey represent di police) and Lucas Koyejo (from di National Human Rights Commission).

Immediately afta di panel rule in favour of LCC, one Senior Advocate of Nigeria, Ebun-Olu Adegboruwa waka enta di room with di oda three members of di panel, Patience Udoh (wey dey represent civil society), Rinuola Oduola and Temitope Majekodunmi (wey dey represent di youths).

And dey all say dem no dey in support of LCC to re-take ova and reopening di Lekki toll plaza.

Lekki Toll Gate Lagos Judicial Panel [Nigeria EndSARS protest]: Rinu Oduala
Wetin we call dis foto, Venue for di Judicial Panel na: Lagos Court of Arbitration. 1A, Remi Olowude Street, 2nd Roundabout, Lekki - Epe Expressway, Lekki Phase 1, Lagos.

Dis investigative body wey dem set up na to look into reports of abuse by former Special Anti-Robbery Squad aka SARS. Di police unit dey face accuse of plenty human rights violations.

Di Lagos State Judicial Panel on Restitution for victims of police brutality and other related matters begin public hearing on Tuesday 27 October, 2020.

Di initial plan for di wey dem set up na to investigate historical abuse by SARS. But Lagos state governor, Babajide Sanwo-Olu, announce say dem expand to include 20 October, 2020 shooting.

Members of di panel include Segun Awosanya, Lucas Koyejo, Esq, Taiwo Lanu, wey be retired Deputy Inspector General (DIG) of Police, Patience Udoh, Doris Okuwobi wey be retired justice of Nigerian judiciary, Ebun Adegboruwa, SAN, Oduala Balatito Olorunrinu, Majekodunmi Temitope Oluwaseun and Oluwatoyin Odusanya.

Everi state for Nigeria don launch dia own own judicial panel of inquiry, afta weeks of protest wey call for end to police brutality.