You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Chinese new year 2022: Five facts about 'Lunar New Year' holiday dis year
As di entire world happy for 1st January, 2022 to welcome di new year, anoda set of celebrations dey ground for pipo from various parts across di world.
Dis na di Lunar New Year wey also dey known as di Chinese New Year or Spring Festival and e dey always fall afta new year celebrations.
Di start of di new Lunar Calendar dis year 2022 fall on February 1 and mark di Year of di Tiger, one animal wey symbolise strength and being brave.
Chinese New Year, every year, dey associated with di 12 animals wey represent 12 zodiac signs.
Dis animals na rabbit, dragon, snake, horse, goat, monkey, rooster, dog, pig, rat, ox, and tiger. For example, di Lunar New Year 2021 na di year of Ox.
How dem take celebrate Chinese New Year 2021 - di year of Ox
Di last Chinese New Year happun for February 12, 2021 and dis na dia biggest holiday.
China dey arrange dia own calendar year according to di moon (Lunar calendar) and dem get correct celebrations even as go slow dey plenti as pipo dey try go to dia village to celebrate.
Di new year dey start with di new moon between Jan 21 and Feb 20.
End of Di one wey oda users dey read well well
See some tins wey you fit no know
For Chinese tradition, dem name each year afta one of di 12 animals wey dey feature for di Chinese zodiac: Rat, Ox, Tiger, Rabbit, Dragon, Snake, Horse, Goat, Monkey, Rooster, Dog and Pig.
So di animals get every year wey dem go dedicate to am once every 12 years for one circle. Year 2020 na di beginning of anoda 12-year cycle.
Dem believe say pipo wey dem born fo di year of di ox dey devoted to work and also dey very morally upright but dem be bad communicators.
How Chinese dey take celebrate new year
Before di festivities start, pipo go clean dia house well to make dem ready for di celebrations.
Den wen di New Year Day come, di tradition be say dem no dey hold broom make dem for no sweep di goodluck wey dey come for di new year comot from di door.
Di festivities dey last for two weeks. Dem go finish am with special lantern festival wey go mark di end of di new year celebration period.
Wetin be di believe behind some of di celebrations
Dis na di period wey children dey cash out bad-bad on top say adults dey usually give dem money for inside red envelopes.
Dem dey also light fireworks on top say dem believe say di light and sound go make fear catch evil spirits, make dem run away for di coming months. E fit work for Covid-19?
Oda Kontris wey dey celebrate Chinese new year
No be only for China dem dey celebrate di new year, Korea sef dey join for di celebration for wetin dem dey call di Seollal festival.
For di event, dem go wear dia traditional clothes (hanbok) go meet dia grandparents to greet dem.
Dem dey chop rice cakes traditionally in hopes say dem go get good luck.
Oda kontris wey dey celebrate am as holiday include Hong Kong, Malaysia, Singapore, Taiwan and Vietnam