Chinese New Year: 2020 na 'Year of Rat' for China, and dis na wetin e mean

Dis week, millions of pipo from different communities all ova di world dey celebrate di Chinese New Year.

For Chinese tradition, dem name each year afta one of di 12 animals wey dey feature for di Chinese zodiac: Rat, Ox, Tiger, Rabbit, Dragon, Snake, Horse, Goat, Monkey, Rooster, Dog and Pig.

So di animals get every year wey dem go dedicate to am once every 12 years for one circle. Year 2020 na di beginning of anoda 12-year cycle.

2018 na di year of di dog, 2019 na year of di pig and 2020 go be di Year of Rat.

Wetin be di tori of di Rat?

For Chinese culture, dem dey see rats as sign of wealth and plenti

Di Rat na di first of all zodiac animals.

According to one myth, di Emperor tok say dem go decide di order of di animals according to how dem take reach di party.

Di Rat deceive di Ox make e give am ride.

As dem dey reach di finish line, di rat jump down, land for front of di Ox and im become first to land di party.

Traditionally married couples dey pray to these rodents wit hope say di way rats dey born, dem sef fit dey born like dat.

Believe be say di pipo wey dem born for di Year of Rat dey get energy and dem dey optimistic.

When di Chinese new year dey start?

Chinese New Year dey start on 25 January 2020.

Di reason wey di year fall for dis time na because e mark di beginning of di lunar new year, wey be di start of a new moon.

Dis one different from di 'Gregorian' calendar wey dey always start for January 1.

Because e dey depend on di moon, di date of di Chinese New Year dey change every year but e dey come January 21 and February 20.

Dem dey also call di Chinese New Year - di Spring Festival.

Na im be di ogbonge celebration for di Chinese calendar.

Before di festivities start, pipo go clean dia house well to make dem ready for di celebrations.

Den wen di New Year Day come, di tradition be say dem no dey hold broom make dem for no sweep di goodluck wey dey come for di new year comot from di door.

Di festivities dey last for two weeks. Dem go finish am with special lantern festival wey go mark di end of di new year celebration period.