Trump impeachment: Senate go begin Trump impeachment trial next week

Donald Trump

Wia dis foto come from, Getty Images

Donald Trump's impeachment trial ova im role for di deadly US Capitol riot go begin next in di Senate, dis na according to di Democrats.

On Monday, di House of Representatives go deliver di impeachment charge to di senate , wey go trigger di trial process inside di 100-member chamber.

Republicans don argue say make dem delay am as dem ask for more time to prepare.

Oga Trump fly go Florida afta im term end on Wednesday and e no attend im successor Joe Biden's inauguration.

Di House of Representatives last week bin accuse Oga Trump say e incite deadly riot for di US Capitol , which dey give way for a Senate trial. If dem find am guilty, dem fit bar am am from future office.

Top Senate Democrat Chuck Schumer on Friday tok say di House go deliver di impeachment article on Monday. Unless Democrats wey don become di majority change di rules dis week, e go mean Oga Trump's trial go go begin on Tuesday.

''Di Senate go conduct a trial of di impeachment of Donald Trump. E go be a full trial. E go be a fair trial'' Senate Majority Leader Schumer tok dis for di floor of di Senate.

Oga Trump's action before di 6 January riot dey di heart of di case.

Di then president bin tell protesters wey dey near di White House make dem ''peacefully and patriotically'' make dem voice heard as dem dey prepare to march toward di US Capitol building. E also tell dem to ''fight like hell''

American Senate go fit comot Donald Trump from office before Joe Biden take office?

Short answer no, but dem go fit run President Donald Trump impeachment afta di inauguration of Joe Biden as di new president of di United States.

Dis dey come afta US Republican Senate Leader Mitch McConnel bin tok for statement say "on top di kain rules, procedures and Senate precedents wen e dey di mata of presidential impeachment trials, e no dey possible say we go get fair or serious trial wey fit finish before dem swear in the President elect Joe Biden next week."

And if Senate convict Trump, e fit be di end of im political dream to run for office for 2024.

Some Republicans don point out say going on with di impeachment fit divide America even more and affect di work of Joe Biden to reunite di kontri.

Even sef Joe Biden don ask weda Senate ft run part-time trial for Trump, so dem go fit focus on oda tins like confirmation for im cabinet and legislation.

Although di impeachment no go fit hold wen im dey office (till next week) but afta wards two thirds of the Senate go need to vote in order to comot am.

Capitol Hallrioter

Wia dis foto come from, Getty Images

Currently both Republicans and Democrats get di same amount of seats for Senate so at least 17 republican senators go need to side with di democrats to make am happen.

If dem convict am under the article of impeachment, e mean say dem go need to vote again to block am make e no run for anoda elected office again, sometin wey im bin dey plan for 2024.

Na on Wednesday, Congress bin vote to impeach am for di the second time wen dem accuse am say na im use im mouth cause di kata-kata for Capitol Hall last week wey kill five pipo.

Dis go make am di first president for American history wey don chop impeachment twice for one term.