Capitol Hill protest: Trump blocked from Twitter and Facebook, oda tins wey happun afta Donald Trump supporters storm Congress to protest US election result

Capitol Hill

Wia dis foto come from, Reuters

Read am in 4 mins

Washington DC police say four pipo don die during di storming of di Capitol building on Wednesday.

In addition to di woman wey police shoot, three odas die as a result of "medical emergencies".

So far, more dan 52 pipo don dey arrested - 47 of dem, sake of curfew violations.

Dis one na afta Pro-Trump protesters storm Capitol Hill, wia Congress bin dey do joint session to certify di results of di 2020 election - and Joe Biden win.

Congress stop di session as di violence dey go on, but later meet again afta di violence to certify Joe Biden election win.

Violent scenes from Capitol hill

Wia dis foto come from, Reuters

How di Capital Hill protest take happun

E start afta di good news for Democrats as e be like say dem go take control of di US Senate with two projected wins for Georgia

President Donald Trump address im supporters for Washington DC, say e no go concede and say now no be di time for "weakness"

As Trump wrap up im speech, Congress meet for a joint session to certify di results of di 2020 election - and Joe Biden win. Na di final step before Biden's inauguration as the 46th president on 20 January

Police draw dia weapons inside Senate as protesters bin wan climb in

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Police draw dia weapons inside Senate as protesters bin wan climb in

One large group wey bin wan scata di proceedings for Congress, pro-Trump supporters by-pass di barricades, jump walls and force lawmakers to evacuate di premises. Di violence continue for hours.

Di mob - some wey wear body armour - use chemical irritants to attack police, according to Washington Metropolitan Police Chief Robert Contee.

Dem shout and waved pro-Trump and US flags as dem roam di halls, dey demand make dem overturn di results of di presidential election.

Several thousand National Guard troops, FBI agents and US Secret Service na im dem deploy to help di Capitol police wey no fit handle am alone.

Authorities recover two pipe bombs, one from di Democratic National Committee offices, not far from di Capitol, and one from di nearby Republican National Committee headquarters.

DC National Guard deploy go di Capitol, to back up law enforcement for di place.

Wednesday attack na di first time dem go break enta di US Capitol since di War of 1812, according to US Capitol Historical Society experts.

British troops, wey Vice Admiral Sir Alexander Cockburn and Major General Robert Ross lead - set fire to di still-under-construction Capitol afta dem invade DC for August 1814 (though di building survive thanks to rain).

In retaliation for di Americans burning of Upper Canada capital for York one year earlier, di British troops also set fire to oda parts of di city, including di White House.

Di remains of di Capitol afta di British attack

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di remains of di Capitol afta di British attack

Wetin don happun since den?

Social media giants don announce say de go bar President Donald Trump account.

Twitter announce say President Donald Trump account go dey locked for di next 12 hours due to im tweets about di election earlier today.

"As a result of di unprecedented and ongoing violent situation fo Washington, DC, we don ask for di removal of three @realDonaldTrump Tweets wey dem post earlier today for repeated and severe violations of our Civic Integrity policy," di social platform tok.

If Trump no remove di three tweets in violation, di account go remain locked.

Facebook don also tok say dem go bar President Trump from posting for di next 24 hours.

Di company cite policy violations ontop di president page.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Meanwhile di mayor of di US capital city don extend public emergency for 15 days until afta inauguration day.

Di order lasts until 15:00 on 21 January, di day afta Bid dem go swear Biden in.

Di city dey already under curfew dwey di Mayor declare from 18:00 on Wednesday to 06:00 (23:00 to 11:00 GMT).

Members of Congress take cover as protesters enta

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Lawmakers take cover as protesters enta Congress

How global leaders react

Global leaders don dey express dia shock over di attack for di US capital.

  • Canadian Prime Minister Justin Trudeau say "Canadians dey deeply disturbed" by di "attack on democracy".
  • Argentina President Alberto Fernandez express im support for Joe Biden and condemn di "serious acts of violence".
  • President Ivan Duque of Colombia also reject di violence and offer im support to members of Congress.
  • Chile President Sebastian Pinera condemn "di actions seeking to alter di democratic process".
Protester with di Speaker lectern

Wia dis foto come from, Getty Images

Facts of di US election results

Dis na probably good time to go over di facts of di election results, contrary to wetin President Trump dey tok.

  • Democrat Joe Biden win 306 votes to Trump 232 for di US electoral college, wey confam di US president. Biden far surpass di 270 im need to win di presidency
  • For di popular vote, Biden secure at least seven million more ballots dan Trump
  • Trump campaign don file nearly three dozen lawsuits wey challenge di election results. All no get head
  • Trump appointee Attorney General William Barr, wey resign for December, sy last month say im justice department no find proof to back Trump comments ontop election fraud