School resumption in Nigeria update today: Federal government decide to reopen schools January 18

University of Ibadan gate

Wia dis foto come from, OTHER

Federal Government of Nigeria don decide to go ahead with di January 18 earlier date for all schools inside di kontri to resume.

Dis na afta Federal Ministry of Education do comprehensive appraisal of di situation of tins and serious consultations with relevant stakeholders, including State Governors, Commissioners of Education, Proprietors and heads of institutions, staff unions and students.

Afta di consultation, all of dem go agree say make di resumption date of 18th January remain, while parents and every institutions must folow full compliance with COVID-19 protocols wey include;

  • Compulsory wearing of Facemasks by all students, teachers and workers inside all schools.
  • Temperature checks and hand washing facilities wey go dey strategic locations inside all schools
  • Constant supply of water and sanitizers
  • Make sure say pipo maintain social distancing and stop large gatherings like assembly and visiting days.
  • Avoiding overcrowding, including limitations inside class sizes and hostel occupancy.
  • Make sure say functional health clinics dey available with facilities for isolation and transportation of suspected cases to medical facilities
  • Obey all oda non-pharmaceutical protocols, restrictions and containment measures according to wetin di e PTF prescribe/ approve from time to time.

For di statement wey ministry of Education bring come out, dem add say dem go constantly review all dis measures wey school must follow for dia reopening and advise teachers, school administrators and oda stakeholders to ensure strict compliance.

Nigeria goment bin first tok say dem wan bin review di January 18 resuption date sake of di econd wave of COVID-19 wey dey affect di kontri.

Di Minister of Education, Adamu Adamu tok dis one as e dey ansa kwesion during di weekly press briefing by di Presidential Task Force on COVID-19 for Abuja.

Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) daily Covid case chart don go up for di last weeks as di number infections dey increase since di beginning of di 2021.

Di PTF bin don yan say di way wey di number of cases dey go up, e pass be careful and dat di increase na sake of say Nigerians no dey obey covid -19 protocol.

Although di task force don kontinu to yan say dem no dey consider total lockdown again for di kontri sake of di economy, dem also explain say if pipo no follow di protocol, goment no go get any oda option.