You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Deeper Life school saga: Parents demand N100million naira compensation
Di parents of di 11-year-old JSS1 student of Deeper Life High School Uyo, wey bin allegedly dey sexually molested, don demand di sum of N100million compensation for di inhuman torture dia son suffer for di school.
Dis informate dey for letter dem send to di Principal of di school, through dia lawyers, Eagle-Eyes Network Chambers, wey one David Okokon sign.
For di letter wey dey dated 22 December, 2020, di family dem give Deeper Life High School Uyo, 21 days to pay di compensation money.
Dem also demand make di school publish unreserved apology for two National Newspapers and any oda two local newspapers wey dey circulate within Akwa Ibom State and its environs.
Di school neva respond to dis latest demand.