You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Deeper Life school saga: Church go give update on alleged sexual assault of 11 years old student
Afta long time of quiet, Deeper Life Bible Church, owner of Deeper Life High School, Uyo, Akwa Ibom state, don do announcement say e go soon address di public on top di case of allege sexual assault on one of dia students.
For message wey dem post for Twitter, di church say "di Education Secretary of di Deeper Life High School go share some update on di case later today."
Di 11 years old JSS 1 student of di Deeper Life High School, mama Deborah Okezie, allege say dem starve and seniors sexually abuse sake of im dey piss for bed.
One hashtag wey call for justice for di boy trend afta im mama enta social media to do many videos on top di mata.
Inside one of di latest videos, she tok about how dem attack her inside di Akwa Ibom state Commissioner for Education office, come order her to remove di videos wey she post becos she dey embarrass di goment afta dem invite her come di office.
But for goment press statement, dem say "e no get any time wey di commissioner for education or any staff of di state goment, harass or intimidate di parent of di affected student, or anybody we dey connected to di mata."
We don update dis tori to reflect di response from di goment