You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Ahmed Musa: Kano Police don arrest fake 'Ahmed Musa' wey dey dupe pipo as Nigeria International footballer
Kano Police Command on Tuesday announce say dem don arrest one Gambo Yakubu wey dey parade himself as Nigeria's Super Eagles captain Ahmed Musa to dey dupe pipo.
According to tok tok pesin of di command DSP Abdullahi Haruna di 30 year old wey dem arrest don colet about N700,000 from different pipo with promise say e go get football club for dem for abroad.
"E bin dey work with Ahmed Musa sports centre before before dem pursue am so e come go forge documents dey dupe pipo." Dis na wetin police officer Abdullahi yan.
Na manager of Ahmed Musa sports centre carry complain go meet police after plenti pipo start to meet dem to enquire about money wey dem pay.
According to police na about 15 pipo fall victim to Gambo after e make dem pay N5,000 for forms as dem wan get club for obodoyibo.
"Di total of wetin e colet na N700, 000 and e say e spend am on im girlfriends and hotels." Dis na wetin police tok tok pesin yan.