Champions league draw: Barcelona go jam Paris Saint-Germain for Champions League last 16

Wia dis foto come from, Getty Images
Barcelona go jam Paris Saint-Germain for di last 16 of di Champions League.
Dis one mean say Neymar go face im former teammates for di first time since im leave dem.
For di last match between di two ogbonge teams on 8 March, 2017, Barca defeat PSG 6-1 after PSG bin don win di first leg 4-0.
Dis dey come after di draws wey happen on 14 Monday for di House of European Football for Nyon, Switzerland.
Anoda top match go be di game wey go see Chelsea clash wit Atletico Madrid.
Meanwhile Real Madrid go jam Atlanta wey knock out Manchester United comot and last season winners Liverpool go face RB Leipzig.
Cristiano Ronaldo club Juventus go play di team from im home kontri Portugal, FC Porto.
Dem go play di first matches on February 16, 17, 23, 24, and di second leg go happen on on March 9, 10, 16 and 17.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
Champions League last-16 draw
- Borussia Monchengladbach v Manchester City
- Lazio v Bayern Munich
- Atletico Madrid v Chelsea
- RB Leipzig v Liverpool
- Porto v Juventus
- Barcelona v Paris St-Germain
- Sevilla v Borussia Dortmund
- Atalanta v Real Madrid

Wia dis foto come from, Getty Images













