Kano man 'Isa' wedding with im American bride don set with blessings from family

Isa Sulaiman and Janine Sanchez go marry for one mosque for Kano on Sunday

Wia dis foto come from, SULAIMAN ISA/FACEBOOK

Mallam Isa Panshekara wey be father to 26 year old Isa Sulaiman wey dey marry 46 year old American Janine Sanchez on Sunday don tell BBC say e support di marriage.

Isa na level 200 student wey dey study Geography for Yusuf Maitama University wey dey Kano while im bride to be Janine na chef for Afghani restaurant wey dey for California.

Di couple become internet sensation when Janine visit Nigeria after months of chatting and video calls with her boo.

For Kano wia Isa dey stay, dem become tok of di town, as anywhere dem go pipo wan see dem.

Isa tok say e get one time wey dem go market but due to how plenti pipo wan take pishures with dem, dem no see road.

Dia marriage suppose happun March but na coronavirus spoil show for dem.

But afta months of waiting, di wedding day don land at last and with blessings from di family.

Isa papa wey be retired police officer say nothing like 100 percent for anything but wetin e know be say di couple get im blessings and e go dey pray for dem.

"I support di marriage and I don give my go ahead but I no go call am 100 percent because as far as I dey concerned, there's nothing like 100 percent for dis life."

"As pesin with security experience before she even come dat first time I visit DSS, NAPTIP to make sure say all di necessary checks happun and I also visit Hisbah and Sharia Commission to consult religious leaders, so problem no dey anywhere."

Regarding di wedding preparations, Mallam Isa yarn say na im advise di couple say make dem no do any oda activity apart from di wedding prayers wey go happun for mosque on Sunday because of security and some oda factors.

Mallam Isa Panshekara na retired police officer

Wia dis foto come from, SULAIMAN ISA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Mallam Isa Panshekara na retired police officer and e say di couple get im blessings

"So apart from di wedding prayer for mosque nothing like oda events again wetin I dey look na di situation of di kontri and also how expensive things be at di moment, to rent hall for event sef na money. By di time dem move go America dem fit do all dia events dia."

"Regarding the wedding prayer, she (Janine) say she wan attend but we tell her say women no dey attend wedding prayer for mosque alongside men."

On weda e go miss im son when e finally move to United States of America, Mallam Isa tok say di boy no go turn im back on Nigeria when e finally move.

Dis kain marriage no dey common for northern Nigeria and dis na some of di reason why a lot of attention dey on top am.

38 year old Kano resident Sani Musa tell BBC Pidgin say dis na di first time wey e see dis kain marriage.

"For southern Nigeria we dey hear about am but for north dis marriage between Isa and Janine na di first wey I know and dis na why many pipo chook eye to see how things go play out."