Odumeje: Abia State governor suspend Chief of Staff for spraying money on Odumeje?

Wia dis foto come from, @okezieikpeazu
Abia State Governor, Dr Okezie Ikpeazu, don suspend im Chief of Staff, ACB Agbazuere from office.
Secretary to di State Government, Barrister Chris Ezem announce dis one on Sunday inside statement.
"Abia State Governor, Dr Okezie Ikpeazu, don direct di immediate suspension from office of di Chief of Staff to di Governor, Dr Anthony Agbazuere," na so di statement read.
E add say Agbazuere suspension na wit immediate effect.
Although dem no mention why, di Chief of Staff bin appear for inside video wia e dey spray one popular Prophet Chukwuemeka Odumeje aka Indaboski for e office.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Di date wey dem shoot di video no dey known.
But di governor say make di Permanent Secretary of di state goment house, Alozie Odoemelam begin perform di duties of di Chief of Staff.






