Bayelsa by election result: Seriake Dickson don win Bayelsa West Senatorial District

Wia dis foto come from, Seriake Dickson/Facebook
Immediate past Governor of Bayelsa State, Henry Seriake Dickson of di PDP don win di Bayelsa West Senatorial District by-election.
INEC Returning officer Prof Okechukwu Okeke of Federal University Otuoke declare am winner wit a total of 115,257 votes against im closest rival, Peremobowei Ebebi of di APC wey get 17,541 votes.
Senator Dickson bin serve of Governor of Bayelsa State from February 2012 to February 2020.
Wit di election of di Bayelsa State Governor, Sen. Douye Diri and Deputy Governor, Sen. Lawrence Ewhrujakpo, two sentorial seats become vacant as Diri bin dey represent di pipo of Bayelsa Central senatorial District while im Deputy bin dey represent Bayelsa West for di Senate.
Bayelsans vote for dis two senatorial seats for di by-election wey Independent National Electoral Commission INEC conduct on Saturday 5 December, 2020.

Wia dis foto come from, AFP
Who be di candidates wey contest dis by-election?
Two strong candidates out of di 13 wey dey contest di Bayelsa West Senatorial by-elections na di immediate past governor of di State, Henry Seriake Dickson of di PDP and a former Deputy Governor, Peremobowei Ebebi of di APC.
Before im become two-term governor, Seriake Dickson bin don be di Attorney General and Commissioner for Justice from 2006 to 2007 wit then Governor, Goodluck Jonathan before im go House of Reps to represent Sagbama-Ekeremor Federal Constituency from 2007 to 2012.

Wia dis foto come from, Facebook
Rt. Hon. Peremobowei Ebebi bin represent Ekeremor Constituency 1 for di first and second Bayelsa State House of Assembly and be di Speaker of di House from 11 June 2001 - 1 June 2003 and 14 November 2005 to 29 December, 2005.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wen Dr. Goodluck Jonathan become Governor after di State Assembly impeach Governor Alamieyeseigha, Ebebi as di Speaker become di deputy governor.
Im still be di deputy governor to Governor Timipre Silva from 2007 to 2012.
Di candidacy of Ebebi for di Senate race bin face some set back wen Federal High Court for Yenagoa on 4 November, 2020 disqualify Ebebi from contesting di senatorial by-election wen one Richman Samuel bring case of forged academic credentials and voters card against Ebebi.

Wia dis foto come from, Facebook
Wit dis judgement, INEC comot Ebebi name among candidates wey dey cleared to contest di by-election.
But on 2 December, 2020 a special panel of di Appeal Court for Port Harcourt, Rivers State overrule di objection of di defendant, come grant stay of execution of di judgment.
Di three -man panel of Judges hold say, "Ebebi remain innocent of fraud. No finding by di trial Court show say im commit fraud."
Di Court come grant di motion for stay of execution of judgment wey come open road for Ebebi to contest Saturday election.
For anoda case against di APC Bayelsa Central candidate, Chief Abel Ebifemowei, di Federal High Court for Yenagoa strike out di case wey one Henry Ofongo bring to disqualify am from di elections.
Oda candidates wey also contest di Bayelsa Central senatorial by-elections, include di immediate past State chairman of di PDP, Moses Cleopas Zuwoghe and former Secretary to di Bayelsa State Goment, Bolere Elizabeth Ketebu under National Rescue Movement NRM Party. She also be di former Batiinsl Presidentof National Council of Women Society NCWS.












