Bayelsa election tribunal: Douye Diri chop sack from Governorship Election Petitions Tribunal wey order fresh election

Bayelsa election tribunal:

Wia dis foto come from, Bayelsa Government News Media

Wetin we call dis foto, Govnor Douye Diri enta office on 14 February, 2020 just one day afta one supreme court judgement knack out di APC candidate David Lyon wey INEC bin declare winner.

Bayelsa State Governorship Election Petitions Tribunal wey dey sidon for Abuja on Monday cancel alias nullify di 16 November, 2019 governorship election wey hold for Bayelsa state.

One three-member panel of di tribunal wey Justice Ibrahim Sirajo lead, rule say INEC unlawfully remove alias exclude di Advanced National Democratic Party from di election.

Di tribunal come order INEC to conduct fresh election within 90 days.

Tori be say na five petitions wey dey before di panel. Dem bin deliver ruling on three petitions on Saturday and di rest two on Monday.

INEC for Bayelsa tell BBC Pidgin say dem just dey see di judgement for local media and afta dem receive am dem go make final statement on dia next move.

Dis election mata na one of di pre-election cases before di Bayelsa election tribunal, according to wetin BBC Pidgin find out.

Dis judgement dey come just two days afta di same election tribunal bin don dismiss di petitions wey Alliance for Democracy, United Peoples Congress and Liberation Movement parties bin file.

Bayelsa election tribunal

Wia dis foto come from, Bayelsa Government New Media

For inside judgment wey all three judges of di tribunal agree to give wey Justice Owodunni deliver on Saturday 15 August, 2020, di tribunal say di petition wey Owei Woniwei of Alliance for Democracy bring no make sense alias dey incompetent and lack merit as dem fail to prove di accuse alias allegation of forged declaration of age and National Youth Service NYSC certificate against di sitting Bayelsa Deputy Govnor, Sen. Lawrence Ewhrudjakpo .

Bayelsa state Govnor Duoye Diri

Wia dis foto come from, Bayelsa State Goment News Media

Wetin we call dis foto, Na just on Saturday 15 August, jubilation bin dey di Bayelsa State Goment House as di state Governorship Election Tribunal wey dey sidon for Nigeria capital, Abuja bin pass ruling wey affirm di election of oga Duoye Diri as Govnor of di state and dismiss three petitions against am.

So as e be so, di tribunal sack Govnor Diri, order fresh election just days afta im bin jubilate say e win case for di same court.

Tori be say court ruling and court judgement on di same mata na two different tins wey fit come out differently.

Remember say dem swear in Douye Diri of Nigeria main opposition Peoples Democratic Party (PDP) as Govnor barely 24 hours to di inauguration of David Lyon of di kontri ruling All Progressives Congress APC afta Supreme Court deliver judgement say im running mate, Sen. Biobarakuma Degi -Eremienyo present false information to INEC (wey be Nieria election office).

Govnor Douye Diri enta office on 14 February, 2020 just one day afta one supreme court judgement knack out di APC candidate David Lyon wey INEC bin declare winner.

Gov. Douye Diri react: "I go ppeal dis judgement"

Bayelsa election tribunal

Wia dis foto come from, Other

Meanwhile, Bayelsa State Govnor Douye Diri say im go appeal di tribunal judgement.

For statement wey di Acting Chief Press Secretary to di Govnor Daniel Alabrah sign, Govnor Diri say im don instruct im lawyers to file di necessary papers.

"We trust di judiciary and we dey appeal di judgement. Wit God on our side, we go get justice. Dis na court of first instance. We get right to appeal even up to di Supreme Court."

Di Govnor come tell members of di Peoples Democratic Part and im supporters to remain calm and law abiding.

INEC explain why dem remove ANDP for di 16 Nov. election wey make Tribunal cancel di election totally

Nigeria election office, Independent National Electoral Commission (INEC) don explain wetin dem sabi about di mata wey make Tribunal cancel di 16 November Governorship election for Bayelsa State.

INEC National Commissioner and Chairman, Information and Voter Education Committee, Festus Okoye, say di nomination for Advanced Nigeria Democratic Party (ANDP) for di election bin dey invalid while di party no exercise dia right wey dey guaranteed for di Fourth Alteration to di constitution to file dia case within 14 days of dat right.

Oga Okoye say di ANDP bin conduct party primaries and submit di name of one Peter David as dis Deputy Governorship candidate.

"As at di time wen dem submit di name of di candidate, im bin dey 34 years-old, wey no follow Section 177(b) of Nigeria law book alias constitution wey make am a must for candidate for such office to rach di age of 35 years to dey eligible to contest di election.

"For di candidate statutory declaration of age and affidavit wey im attach to im form, di party state say dem born am on 10 February, 1985.

"On 13 September, 2019, di commission write to di party come draw dia attention to di constitutional age requirement of 35 years for Governorship/Deputy Governorship candidates as Section 177(b) of di constitution tok.

"Di commission also inform dem say dia nominations for di 16 November, 2019 governorship election for Bayelsa State dey invalid." Im explain.

Okoye come add say on 21 September, 2019 ANDP respond to di letter wey di commission write dem, dated 13 September, 2019 wia dem acknowledge say dia nomination dey invalid come forward di name of one Miss Inowei Janeth as dia new Deputy Governorship candidate.

"On 27 September, 2019 di commission inform di party say 9 September, 2019 na di deadline for di submission of nominations according to di election Timetable and Schedule of Activities wey di commission release on 16 May, 2019 .

"Di commission also inform di party say since dem no submit valid nomination, d no fit validly substitute any candidate. Consequently di name and logo of di party no appear and e no dey reflected for di ballot paper.