Appeal court confirm Douye Diri election as Governor of Bayelsa state

Wia dis foto come from, Facebook
Di Court of Appeal for Abuja don set aside one ruling of di Bayelsa State Governorship election petition tribunal wey nullify di election of Douye Diri as di validly elected governor of Bayelsa State.
For majority judgement wey dem deliver for Abuja on Friday 2 October, 2020, di court hold say di petition by di Advanced Nigeria Democratic Party (ANDP) dey statute-barred, and di tribunal no get jurisdiction to entertain di matter.
Di court also say di tribunal no be di proper place to entertain di petition as e dey wrong to say di candidates of ANDP bin dey validly nominated.
Wetin happun for di election petition tribunal?
Di Bayelsa State Gubernatorial Petition Tribunal for split judgement of two to one on 17 August, 2020 bin don nullify di election of Governor Douye Diri based on a petition by ANDP wey argue say dem bin dey unlawfully excluded from participating in di election.
Di five-man panel of di Court of Appeal wey Justice Adezila Mshelia lead set aside di tribunal verdict come uphold di appeal INEC and di Peoples Democratic Party PDP file against di majority judgment of di Bayelsa state governorship election tribunal and confam Governor Diri election.
Govnor Diri react
Di Governor of Bayelsa State, Sen. Douye Diri say di decision of di Court of Appeal wey uphold im election na di true position of di law.Im acknowledge di five judges of di Court of Appeal as di five wise men wey uphold di law and show say di common man fit go di judiciary get justice and thank dem for doing justice.







