Borno farmers killings: Boko Haram claim responsibility for killing of farmers as Senate ask Buhari to sack service Chiefs

Wia dis foto come from, Boko Haram
Boko Haram don release video wia dem take responsibility for di killing of farmers for Zabarmani and Koshebe towns for Borno state wey dey northern Nigeria.
Dem say dem kill di farmers as revenge for dia fighters wey di towns pipo catch, come hand dem over to Nigerian Army.
Even before dem take responsibility many pipo don already tok say na Boko Haram carry out di Saturday killings.
Dis na based on di fact say di group don dey do similar operations for di state for many years now.
Many pipo still dey tok about di horror of wetin happun as dem use knife slaughter mostly farmers wey go farm to harvest rice.

Wia dis foto come from, BASHIR AHMAD/TWITTER
Sack di service chiefs
Meanwhile, Nigeria senate don ask President Muhammadu Buhari to sack e service chiefs sake of dia failure to secure Nigerians.
Dem ask di goment to replace dem wit new ones shaperly. Dis no be di first time wey di senate di ask goment to sack di service chiefs.
Even as di senate dey tok dat one, di House of Representatives wey be di lower chamber of Nigeria legislative arm of goment don resolve to invite president Muhammadu Buhari to come ansa kwesion on top di security situation for di kontri.
End of Di one wey oda users dey read well well
Some 10 lawmakers from Borno state bin move a motion through Hon. Satomi Ahmed for di floor of di house for di president to declare state of emergency on top security mata for di kontri.
Dia call dey happun days afta Boko Haram pipo dem slaughter more than 40 farmers for Borno state north-east Nigeria.
But as oga Satomi Ahmad finish to read di motion, one oda lawmaker from Borno state, Hon. Ahamdu Jaha wey rely on order 6 rule 1 for di house say di original motion wey di lawmakers from Borno state bin agree on na for di president to show before dem to explain wetin dey happun for di kontri especially for di north-east.

Wia dis foto come from, @HouseNGR
E come demand make dem amend di prayers of di motion to show dia desire to invite di president.
Oda lawmakers bin agree to im amendment for di presido to show face for di lower house but di Speaker, Femi Gbajabiamila say dat one no dey necessary and dat di earlier state of emergency wey di lawmakers bin demand don do
But di lawmakers reject oga Gbajabiamila suggestion
Di majority leader of the House, Ado Doguwa also beg di lawmakers make dem no summon di president but like thunder di lawmakers shout no.
As tension begin to rise, di speaker come ask for executive session to resolve di mata and dem come decide say now be di right time for di president to explain to dem wetin dey happun for di kontri












