US election: Why Judge troway Trump lawsuit for Pennsylvania

Wia dis foto come from, Reuters
One Judge for Pennsylvania don troway one lawsuit wey Trump campaign carry come im dormot wey claim say millions of mail-in votes for di battleground get comma inside.
Judge Matthew Brann say di case, wey dey claim say get plenty mago-mago "lack merit".
Di move don open way for Pennsylvania to next week certify Joe Biden victory- him dey lead by more dan 80,000 votes.
Dis na di latest blow to Donald Trump wey dey try overturn im loss for di 3 November presidential election.
Im no gree accept di result and im dey claim say plenty mago-mago dey di election, without providing any evidence.
Trump failure to accept di result don affect di process wey dey normally follow di US election.
Tori be say based on projection Oga Biden dey expected to defeat President Trump 306 to 232 for di US electoral college, wey dey determine who go become president- dis dey above di 270 wey im need win.
Trump campaign don lose some of dia lawsuits wey dey contest di election results, and dis latest effort bin focus to stop di swing states wey hand Oga Biden im win certifying di results- and na essential step for di Democrat to formally be declared winner.
End of Di one wey oda users dey read well well
Pennsylvania judge verdict
For di ruling Judge Brann write say Trump campaign try to "deprive almost seven million voters".
Him say dem present im "court wit strained legal arguments without merit and speculative accusations".
"For United States of America, dis no fit justify deprive a single voter, let alone all di voters of di sixth most populated state," na wetin di judge write.
Di Trump campaign bin argue say di state violate di US Constitution's guarantee of equal protection under the law as some Democratic-run counties wey allow voters to fix errors for their ballots while Republican-run counties no fit do same.
President Trump personal lawyer, Rudy Giuliani, tok for inside statement say him go appeal against di ruling: "Today decision turnout to help us in our strategy to get to US Supreme Court."












