Lewis Hamilton: Di British driver win him seventh Formula 1 title to equal Michael Schumacher record

Wia dis foto come from, Reuters
Lewis Hamilton win im seventh World Championship to became di most successful racing driver ever afta im win di Turkish Grand Prix on Sunday.
Tori be say di Mercedes driver now don equal Michael Schumacher achievement in terms of titles, afta im pass di German number of race wins last month.
Him Victory for di wet and slippery Istanbul Park track race na im 94th for di career of di British driver.
As im team congratulate am, Hamilton wey be 35 years old bin dey emotional inside di car afta di race, e say: "To all di kids out there, dream di impossible."
Once im comot from di car, im add say: "Seven dey unimaginable but when you work with a great group of pipo and you really trust each oda, you fit achieve anything together.
"I feel like say I just dey start, e dey really weird."
Hamilton, who no get contract for next year, say him go "love to stay" for F1 and want to continue to campaign for change when it comes to human rights, diversity and environmentalism.

Wia dis foto come from, BBC Sport








