Mozambique vs Cameroon: Indomitable lions don cement place for group F wit 10 points

Vincent Aboubakar

Wia dis foto come from, Mouamba Lyonga

Wetin we call dis foto, Vincent Aboubakar score two goals as di Indomitable Lions go top of Group F.

Following return leg for Zimpeto natiional Stadium for Maputo, Indomitable Lions punish de Mambas 2-0 for pick three points. Aboubakar Vincent weh e score two goals for first leg score Cameroon first goal for first half before Serge Tabeku add number two for send half. Cameroon di top group F with 10 points for day four Afcon qualifiers and deh bi host for 2022. Mozambique try everything for front home fans but dia luck no shine as deh no score any goal

Antonio Conceicao, Cameroon coach since September, 2019 give Cameroon football lovers satisfaction as e win dis match since e take over national teamIndomitable Lions kneel for sing national anthem for remember de seven pikin dem weh deh die for Kumba for October 24.