Davido new album: When 'A Better Time' album dey drop?

Davido and im son

Wia dis foto come from, Twiitter/@davido

Read am in 2 mins

Davido don reveal di tracklist for im third studio album - A Better Time, less than a year afta im release A Good Time.

For social media post, di Nigerian star, bin reveal di tracklist of di album togeda wit di different artists wey im feature.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

E announce say im go release di album for Friday, di 13th of November, 2020.

Di 17 track album bin feature foreign artistes dem like Nicki Minaj, Chris Brown, Young Thug, Nas, Lil Baby, and Hitboy, e also include African stars like Sauti Sol, Mugeez and Sho Madjozi.

Nigerians stars like, Tiwa Savage, Mayorkun, C Kay and Bella Shmurda also feature for dis new release wey go be di musician third studio album.

Many pipo don dey yarn about di album before e drop as Davido bin don release two singles from di album wey include Fem and So Crazy wey feature Lil Baby.

Some pipo yab di soon to be released album, sotay Lil Baby tok say im no go dey feature for songs again.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

While some fans dey hail di album say e go be anoda banger for di Nigerian music industry, odas dey hate one of di singles of di album say e be trash.

Tweet

Wia dis foto come from, Twitter

Tweet

Wia dis foto come from, Twitter

Tweet

Wia dis foto come from, Twitter

Tweet

Wia dis foto come from, Twitter

Tweet

Wia dis foto come from, Twitter

Tweet

Wia dis foto come from, Twitter