US election 2020: Joe Biden don win di presidency

Joe Biden

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 1 mins

Joe Biden don win di race to become di next US president, as im defeat Donald Trump for di tight vote count after Tuesday election.

Di BBC torchlight say Oga Biden don reach 273 electoral college votes, meaning say e go become di president for January, pending di outcome of any legal challenges.And na di end be dat, after long wait, now im don cross over di threshold of di 270 electoral college votes e bin need.

Di result make Trump di first one-term president since di 1990s.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Oga Trump campaign don indicate say dia candidate no plan to accept di outcome.

Di BBC declaration of Oga Biden victory dey based on unofficial results from states wey don already count dia votes finish, and go di results wey states like Wisconsin -wia counting still dey on - go produce.

Donald Trump and im mirror image

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Oga Trump campaign don indicate say dia candidate no plan to accept di outcome.

Di election don see di highest turnout since 1900. Oga Biden don win more than 73 million votes so far, di most ever for US presidential candidate. Oga Trump get almost 70 million, di second-highest tally for history.

Earlier Oga Trump bin falsely declare imsef winner when vote counting still dey go on, but e no present evidence to support im tok for social media.