US election 2020: How many votes Kanye West finally get?

Kanye West performs at Coachella

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Will we be seeing a President Kanye?
Read am in 2 mins

We no know - still - who go be di next US president, but we know say di winner no go be - Kanye West.

Di 43-year-old rapper don concede after e self-styled "Birthday Party" collect just 60,000 votes out of estimated total of 160 million.

Another independent, Libertarian Jo Jorgensen, make stronger showing - as e claim more than 1.5 million votes.

But Kanye political career fit no dey over just yet. E tweet "Kanye 2024" dis week, to signal another bid to come.

For di first presidential attempt, West appear on di ballot for 12 states, as e miss di filing deadline for most others. He gather di most votes - 10,188 - for Tennessee, state wey dey typically favour Republican candidates.

When e announce im candidacy for July, West bin say e platform bin dey modelled off Wakanda, di fictional kingdom from Black Panther.

To End police brutality bin be e number one plan, he tell Forbes for interview, like cleaning up chemicals "for our deodorant, for our toothpaste", and dey focused to protect America with dia "great military".

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

And why di party name?

"Because wen we win, na everybody's birthday party," na so e tok.

But Kanye candidacy bin be di subject of much criticism - and concern about e health.

For one rally for Charleston, South Carolina, to officially launch e campaign, di star make several surprising rants, at one point e say di 19th century abolitionist Harriet Tubman "never actually free di slaves, she just had di slaves go to work for other white people".

Kanye later begin cry wen e begin talk about abortion, as e say im parents almost abort am, and e bin wan abort e daughter.

Di rapper disclosed last year say e get bipolar disorder and e wife, Kim Kardashian West, post on social media during e run wia she ask for "compassion and empathy" for Kanye whose "words sometimes no dey with e intentions".