Turkey earthquake for Aegean coast shake Izmir province and Greece Island of Samos

A man walks among debris of collapsed buildings after a magnitude 6.6 quake shook Turkey's Aegean Sea coast

Wia dis foto come from, Anadolu Agency via Getty

One powerful earthquake don hit Turkey coast of Aegean, wey dey north of di Greek island of Samos, officials tok.

Di tremor of up to 7.0 magnitude shake di coast of Turkey Izmir province, di US Geological Survey (USGS) bin tok, and pipo wey dey as far as Athens and Istanbul feel am.

Turkish officials tok say so far dem no get report say anybody die but six buildings na im collapse for Izmir city.

Turkey and Greece dey area wia earthquakes dey common.

Map locator

Video on social media show pipo dey search di buildings wey collapse but we not fit verify di footage as at now.

Witnesses say pipo rush comot enter streets when di earthquake happun.

For January more than 30 pipo die and more than 1,600 injure when earthquake nack Sivrice for Turkey eastern Elazig province.

A view of a damaged site right after a quake shaking Turkey's Aegean Sea coast

Wia dis foto come from, Anadolu Agency via Getty

For July 2019, di Greek capital Athens experience tremor wey affect electricity for di city.

One powerful quake wey hit Turkish city of Izmit, near Istanbul, for 1999 kill about 17,000 pipo.

A view of a quake damaged site right after a magnitude 6.6 quake shaking Turkey's Aegean Sea coast

Wia dis foto come from, Anadolu Agency via Getty