For Pictures: Big earthquake wey shake Mexico

Photos don dey come from di 7.1 magnitude earthquake wey happen for central Mexico wey destroy plenty buildings, still kill more than 200 people.

For central Mexico, dey send di army to go help for di rescue work, wey don dey go on throughout di night.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, For central Mexico, dem send di Army to go help for di rescue work wey don dey go on throughout di night
Across Mexico City, group of rescue workers and volunteers use shovel and dia bare hand carry blocks from di broken pieces of buildings wey di earthquake fall.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Across Mexico City, group of rescue workers and volunteers use shovel and their hand take carry blocks from di broken pieces of buildings wey di earthquake fall
Plenty-plenty volunteers join emergency service for di search for survivors.

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Plenty-plenty area people volunteer to join emergency service for di search for survivors
Crowds of volunteers and parents join rescue effort wey dey go on for Enrique Rébsamen elementary school wen collapse for Coapa, South-east of di capital, wey be Mexico City.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Plenty-plenty volunteers and parents join rescue effort wey dey go on for Enrique Rébsamen elementary school wey collapse for Coapa, South-east of di capital, wey be Mexico City
People wey dey stay for Mexico city use bucket to help remove rubble from one collapsed building.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, People wey dey stay for Mexico city even use bucket to help remove rubble from one building wey collapse
Di earthquake happen for during lunchtime, e make people begin run up and down for di streets of Mexico City.

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Di earthquake happen for during lunchtime; e make people begin run up and down for di streets of Mexico City
Di vibration wen happen because of di quake punch holes for di side of multi-storey buildings wey dey for di capital.

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Di vibration wey happen because of di earthquake put holes for di side of multi-storey buildings wey dey for di capital
Some buildings collapse and people dey try to climb over di building to go look for who survivor.

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Some buildings collapse and people dey try to climb over di building to go look for who survivor
People just dey surprise for street dey look things wey di strong earthquake don destroy.

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, People just dey surprise for street, dey look things wey di strong earthquake don destroy
Cars dey buried for under di rubble.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Some parts of buildings wey collapse bury cars for ground as dem begin fall on top dem
Di quake happen just over a week after another quake killed 90 people.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di quake happen just over a week after another one bin kill 90 people
Mexico City transport system praise di work of di volunteers and rescue workers with tweet of di photo of one tired emergency worker wey dey travelling for di city metro.

Wia dis foto come from, MetroCDMX

Wetin we call dis foto, Mexico City transport system praise di work of di volunteers and rescue workers; dem tweet photo of one tired emergency worker wey dey travel go help people