Kumba Massacre: Timeline of weti happun for Mother Francisca International Bilingual Academy for Southwest Cameroon

Students die and odas injure wen gunmen attack Mother Francisca International Bilingual Academy for Fiango Kumba, Même division Southwest Cameroon on 24, October 2020.
Di Kumba killings na drop of blood weh e too much, one of de many killings for Anglophone regions. De Kumba attack make kontri pipo say 'enough is enough, say de killings must stop and Anglophone crisis must end.
But weti happen for kumba?
Day start normal for K-town, Southwest region of Cameroon, pikin dem go school for learn book, for Mother Francisca International Bilingual Academy.
But some pikin dem no bi fit suspect say na dia last day for dis world.
Witnesses say gunmen in army uniform, on top motorcycles, wit guns, open fire for school pikin dem for Mother Francisca International Bilingual Academy for Fiango quarter for Kumba for dat October 24.
Gunmen shoot 19 pikin dem, 9-13 years, three bi die immediately, odas die for road and for hospital, one die de next day.
Just now, seven die, six out of 12 di fight for dia lives as dia condition worry.
Dis wowo incident happen for Southwest Cameroon, one of de two crisis hit Anglophone regions.
End of Di one wey oda users dey read well well
Kumba na one of de latest incident for crisis weh e start for Anglophone regions for 2016, den turn to fight between goment and separatist forces.

Wia dis foto come from, Tamfu Ciduan
Kumba attack timeline
- October 24: shooting, families craiy as deh see die body for dia pikin dem, hospital, Doctors Without Borders busy try for safe pikin dem wit wounds
- October 25 : through Rene Emmanuel Sadi, goment tok- tok pesin accuse separatist say de carry out de school attack
- October 26: prime minister, Joseph Dion Ngute announce mission for go give sorry message for families
- October 27: woman dem komot march for Yaoundé, craiy de pikin dem weh deh kill for Kumba call for women for oda regions for march, call for ceasefire
- October 27: President Biya condemn de killings, order investigate, promise for punish de killers
- October 27: Goment delegation with three ministers, territorial administration, basic and secondary education go give sorry message families , tok wit population for Kumba. Woman den komot craiy.
- Bamenda women dem komot march go governor e office say deh don tire de killing.
- October 28: separatist group for Samuel Ikome Sako give reasons why deh no get hand for de attack, blame goment, say make kontri pipo keep dia pikin dem for house till further notice. Deh tok how de gunmen komot for pick up den take motorcycles for go attack.
- October 28: Pope say make dis kana killings Kumba no happen again
- October 28: President Biya decree national day for craiy dia for de pikin dem weh deh die for Kumba
- October 28: Goment say deh kill separatist fighter weh e kill school pikin dem, di find e 10 kombi dem for de crime.
World reactions
From wen de attack happen, kontri pipo start condemn' am push more for end de Anglophone weh e bring all de killings. Social media flop with #kumbaKillings, #KumbaMassacre #EndAnglophone crisis.
United Nations Humanitarian agency, OCHA, African Union president, Moussa Faki Mahamat, UNICEF Director, United Nations SG, Antonio Guterres, US Embassy, rights groups, musicians, Brenda Biya and oda pipo join for condemn de killings.
UN SG write say make parties listen to call for ceasefire say UN bi available for support dialogue wit all man for solve de crisis weh e don cripple NW and SW regions.
33 groups, join call for action from global campaign for peace and justice say Kumba attack no bi de first from any and separatist, deh di mount pressure make Biya address de root of de crisis.
Na de first taim Cameroon di witness dis kana killings?
No bi de first taim Cameroon di witness dis kana killings. Oda killings happen for big Babanki for northwest, Ekona for Southwest. De one weh e hot laik Kumba na Ngarbuh for Donga and Mantung division weh investigate show say army kill 22 pipo including women dem and pikin dem.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Schools start for Cameroon inside Coronavirus period afta seven months for October 5.
But no bi all school start for Anglophone regions wit de crisis weh e do still go on since 2016.
Separatist fighters don stop pikin dem for go school before as deh di use use for achieve dia aim for form separate kontri 'Ambazonia'.
Anglophone Crisis start for 2016 and till today, 3000 pipo don die, 600,000 run go odas areas, 60,000 forNigeria.











