EndSARS Protests: Adamu Garba petition Twitter Jack Dorsey $1bn damage for #EndSARS protests

Former Presidential Aspirant don sue Twitter

Wia dis foto come from, Adamu Garba/Twitter

Read am in 1 mins

One former Presidential aspirant, Adamu Garba, don drag founder of Twitter, Jack Dorsey, go court sake of accuse say im support di End SARS [#EndSARS] protests across Nigeria.

Tori be say Jack Dorsey bin share di bitcoin donation link of Feminist Coalition, wey be di organisation wey dey raise and distribute funds to protesters wey wan end police brutality.

Garba also don ask di Federal High Court for Abuja to declare di #EndSARS protests for di kontri as illegal.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Garba file di in lawsuit with support of order II Rules 1, 2, 3 of di Fundamental Rights (Enforcement Procedure) Rules, 2009 and Sections 34(1), 35(1) and 41(1) and 43 of Nigeria 1999 Constitution.

Oda pipo wey Garba sue join for di court case include di President of di Federal Republic of Nigeria, di Attorney General of di Federation, di National Security Adviser, di Inspector General of Police, di Director-General of di Department of State Services, di Commandant of di Nigeria Security and Civil Defence Corps and di Nigeria Communications Commission.

#EndSARS protesters don dey streets across Nigeria for almost two weeks sake of fight against di kasala wey di dissolved Special Anti-Robbery Squad (SARS) don cause still dey gada plenti ginger.