Govnor Abdullahi Ganduje Kano don appoint Ibrahim Ibrahim as senior special assistant on Entertainment

Ibrahim Ibrahim, di new SSA entertainment to Kano governor
Wetin we call dis foto, Ibrahim Ibrahim, di new SSA entertainment to Kano governor

Kano state govnor Abdullahi Ganduje don appoint one Ibrahim Ibrahim as senior special assistant on Entertainment.

Dis goment appointment dey among di unusual ones wey happun in recent times after Bauchi govnor appoint special adviser on divorcees and unmarried women and Kano govnor also get special advisers on graveyard matters and streetlights.

According to letter wey secretary to Kano state goment release, dem appoint Ibrahim as senior special assistant on entertainment based on im credentials and im track record.

Di goment letter also tok say di appointment take effect from 6th October 202,0 wey mean say Ibrahim don already begin im entertainment work for goment house as at wen we arrange dis tori.

Di appointment letter

Wia dis foto come from, Kano State Government

Wetin we call dis foto, Di appointment letter

Di appointment dey come at a time wey some young Nigerians wey dey protest about police brutality dey wan shift dia attention to oda issues of governance.