Dissolved: Salihu Tanko Yakasai #EndSARS Twitter post make Kano Abdulahi Ganduje suspend am

Dis na di second time govnor Ganduje dey punish im appointee wey ‘misyan’ for social media

Wia dis foto come from, Kano State Government/ Facebook

Read am in 1 mins

Salihu Tanko Yakasai #EndSARS Twitter post make im oga and Kano Govnor Abdulahi Ganduje to suspend am.

Tori be say Kano state goment for northern Nigeria don announce di suspension of media adviser to di govnor after e criticise President Muhammadu Buhari for Twitter regarding im handling of di #EndSARS protest wey dey happun for Nigeria.

For statement wey Commissioner of Information for Kano Muhammad Garba release on Sunday e add say govnor Ganduje yan say e dey important for public officials to dey very careful with wetin dem dey post online as e fit cause serious trouble.

"Dis suspension (of di media adviser) go start immediately and we also wan use dis chance tok say we dey support di programmes and policies of President Muhammadu Buhari." Dis na wetin part of di statement read.

Salihu Tanko Yakasai bin write for twitter regarding ongoing protest about police brutality for Nigeria say:

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Dis na di second time wey something like dis dey happun for Kano, few months ago after former Chief of Staff to Presido Buhari Abba Kyari die, works commissioner at di time Engr Muazu Magaji bin write on Facebook say e happy wey lead to im sack.