BBNaija new head of house: Nengi na Big Brother new HOH for di lockdown season 5 house

Housemate

Wia dis foto come from, Bigbrother Naija/Africa Magic

Read am in 1 mins

Nengi don become di new head of House for Big brother Naija season 5 lockdown house.

She win di HOH game wey di housemates dey play every Monday.

Dis win mean say she get to stay for the show till di last day and get opportunity to become di winner of di BBNaija lockdown edition.

Dis week Head of house dey take anoda shape as di show don dey reach grand finale.

Out of 20 contestants wey dey di show, na only seven remain.

Every Monday, housemates get opportunity to contest and play game wey go make dem win Head Of House.

Anybodi wey win HOH game go get immunity from eviction for dat week.

Before di Head Of House get opportunity to chose who im go like to be im deputy and both of dem go get immunity for one week and get acess to stay for di HOH lounge

But two weeks to di end of di show, Big Brother change di rule of di game say no more Deputy head of house. na only Head of House go dey.

Biggie come divide di oda six housemates into two groups to nominate housemates wey dem go like put up for eviction dis week.

Laycon, Trikytee, Dorathy and Ozo na who di two teams pick.