BBNaija: How fans vote Lucy comot Big Brother Naija lockdown season 5 house

Wia dis foto come from, @BBNaija Twitter
Lucy na di latest housemate to leave di Big Brother Naija reality television show.
Out of di six housemates wey dey up for possible eviction dis week na she get di lowest votes from di fans
She be di 11th housemates to chop eviction afta Lilo, Ka3na, Eric, Tochi, Kaisha, Prince, Wathoni, Tolanibaj and Bight O.
As e be so, nine housemates still remain for di house out of di 20 wey start di show for July 19.
See how di fans vote for di six housemates wey bin dey up for eviction.

Wia dis foto come from, BBNaija









