BBNaija update today: TrikyTee na im Lucy prophesy to win Big Brother Naija Season 5 lockdown

Lucy Essien on BBNaija update today

Wia dis foto come from, BBNaija

Wetin we call dis foto, On di blond hair, Lucy tok say na experiment on her way to platinum hair

BBNaija evicted housemate, Lucy Essien wey be di newest housemate wey don comot from di Big Brother Naija Lockdown house don prophesy who go win Season 5 lockdown reality show.

For interview wey Lucy wey be businesswoman follow BBC Pidgin do on Tuesday, she tok say she tink say na dat housemate need money pass.

Lucy reveal say she wish say TrikyTee go win di competition.

New head of house BBNaija 2020

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, 35 year old Lagos base, Bayelsa born Trikytee become head of house for di first time

She say since she comot di house na beta-beta vibes she don dey get and feel like say di show don get am ogbonge platform to build her business on top.

She say, "I dey online till 5am dey check wetin dey happun from Instagram and so on and na good vibes I see."

She describe her vibes for di house say na absolute cruise say she come di house to chop life and she shock di kain way her fans keep am for house till now.

Lucy na businesswoman from Cross River southern Nigeria wey don gain popularity online say she dey sell bole.

BBNaija update today

Wia dis foto come from, @BBNaija Twitter

Wetin we call dis foto, Lucy chop eviction for Big Brother Naija house on Sunday 6 September, 2020

She tok say na NYSC cari am from Calabar go Abuja and work cari am come Lagos. Na business she don dey do with her mama for as long as she fit remember.

On di Erica disqualification, Lucy say e bin shock am well-well but she happy wit di way she look for video.

As at di time Lucy prophecy TrikyTee to win di TV reality show, na nine housemates still remain for di show and na only one pesin fit win di 85 milliona naira star prize.

New head of house BBNaija 2020

Wia dis foto come from, BBC/Screenshot

Wetin we call dis foto, Foto: Laycon and TrikyTee on Monday night just afta dem become leaders

Trikytee na di new head of house for Big Brother Naija Season 5 housemates.

Dis na di first time Trikytee dey enta dis role as Head of House since di reality show start on 19 July, 2020.

Trikytee wey real name na Timmy Sinclair win di roll of dice game for di head of house challenge wey di housemates play on Monday.

Im get di highest score for di game to win di title of HOH for di week.