How bad is Lagos traffic? Five signs to show say years of "Lagos traffic" dey destroy you to transport from Mowe Ibafo to Ikate, Ajah/Lekki to Third Mainland Bridge

Lagos traffic na di first attraction you go hear if you tell pesin say you wan come to Nigeria commercial capital.
From traffic for road transport, to road anger alias rage, to flooding, plenti tins dey wey go fit to disturb your wellbeing sake of "Lagos traffic" inside di city wey get at least 20 million pipo.
Dis na five signs wey Lagos traffic fit cause for your social life.

Health Wahala
Deborah Agbeyeke give us gist about how she go comot house by 5am so she go beat traffic for road wen she bin dey stay Ajah and work for Ikoyi and still dey reach house around 9pm.
She say "di mata bad sotay I no dey sleep again, I lose weight and I go watch ceiling until di next day."
Anoda Lagosian, Aless wey be business woman tok say traffic make her sick long before she well.
She say "I bin get back problem for di first month of di lockdown wey bad sotay I get physiotherapy for am.
My doctor prepare recovery plan give me but traffic no let am work.
Imagine afta you don do therapy finish to come sidon for traffic for three to eight hours before you reach di place and as you dey come back.
End of Di one wey oda users dey read well well
E pain me well-well and I stop to dey go come start to dey do am for house."
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post

Wia dis foto come from, Getty Images
Fit scata your relationship
Dr Olive Ogedegbe wey be consultant clinical psychologist tell BBC Pidgin say di stress wey dey come wen pesin spend most of di day for road like "Lagos Traffic" go affect your mood wey be say you fit take am out on you friends or family.
One photographer for Lagos, Seun Brados, tok say e dey affect am relationship wise because e no fit meet di girl im dey chyke because of traffic.

Wia dis foto come from, Getty Images
Mental breakdown
Di mental health palava from "Lagos traffic" dey very possible as pipo wey dey experience am for years fit come down wit anxiety, depression and stress wey fit lead to bigger wahala for future, Dr Ogedegbe tok.
She say "part of di wahala wey be lack of enough sleep dey linked to a lot psychological palava."
Tobi Adebiyi, wey move from Lagos go Abuja say di difference dey clear. "Di fact say I no dey wake up for early mor-mor again to dey go work or to dey think of traffic as I dey go house don dey help my mental health."
Creative artist, Wole Bamgboye tok say "at some point, I bin start to dey get time wey my brain no go record anything for up to thirty minutes."

Wia dis foto come from, Latsma
Reduce your flex
Edwin Okolo wey be fashion designer say e don affect im social life wey don dey very scheduled for am.
E tok say, "most of my friends dey stay 30 minutes away from me, because of traffic if we wan jam ourselves na beta planning we go do."
Deborah tok about how guy invite am make dem go flex, "na so because of di tiredness of traffic for di week, I just sleep as e bin di tok."

Wia dis foto come from, Getty Images
Hustle sef no go gel
Dr Olive tok say lack of sleep and anxiety and di stress of traffic dey reduce productivity, "you no go dey concentrate do di work wey you suppose do because your mind go dey di traffic wey dey road wen you dey return."
Marjorie Fielder wey be business woman tok say, "I no fit hold different appointments for Lagos. If I get like two appointments to do, na to start to dey calculate weda dem dey close to each oda before hold up catch you for road."













