Coronavirus tips: Covid 19 free sex alias kerewa, how pipo dey do am

Coronavirus tips
Wetin we call dis foto, Two pipo dey kissing wit mask

Sake of Covid 19, you fit don dey hear di "new normal" if you enta supermarket or for office wit posters wey say "no mask, no entry".

Well, e don dey for knacks alias knack or kerewa side too, because remember say World Health Organization tok say coronavirus dey move from pesin to pesin from di droplets from nose and mouth.

So wetin don change? For Bolivia, sex workers dey wear face shield and disinfect di room wey dem dey do dia work afta evri customer.

For UK, some months back, goment put law for ground say make pipo no spend di night for house wey dem no dey leave for normally.

New Zealand bin start support bubble wey you go get a particular group of pipo wey you as single pesin fit do physical contact with. Di law also add say once you don enta id bubble, you no fit to dey comot.

Canada's Chief Public Health Officer, Theresa Tam don dey start to advice pipo make dem no dey kiss wen dem dey mekwe or knack alias do kerewa.

Also, she tok say make dey wear face mask during di activity.

But Dr Abimbola Bowale, for m di Lagos State Infectious Disease Centre say e no go really make sense to dey wear face mask for inside house.

Im advise be say, "if you know say possible to say you cari di virus, make you self isolate for two to three weeks."

One Sexual Health charity, Terrence Higgins Trust tok say if you must knack, make you try dis tins to reduce di spread of di virus.

  • Avoid kissing
  • Wear face covering
  • Do positions wey you no go face each other face-to-face
  • Try masturbation

Dr Bowale tok say e neva see for literature say coronavirus dey sexually transmitted but e still dey important to wash your hands regularly to avoid stories dat touch,