Bolivian sex workers dey use facemask, raincoat to keep 'safe' from coronavirus

Pesin wey dey wear fask mask and gloves

Wia dis foto come from, Gaston Brito

Wetin we call dis foto, Di sex workers tok say dia customers dey respect dia decision

Many sex workers for Bolivia tok say dem dey wear gloves, and transparent raincoats and use bleach as dem dey go back to work.

Di Organisation of Night Workers of Bolivia (OTN-B) give dis advise say na e go keep every bodi safe.

Prostitution dey legal for di South American kontri but e dey regulated for brothels wey get license.

Restrictions done ease small afta early lockdown for March.

Vanesa wey be single mama of two say she need di money to fund her education say her customers dey respect di measures wey dem put for ground.

Pesin dey wear transparent raincoat to work

Wia dis foto come from, Gaston Brito

Wetin we call dis foto, Sex workers don det use transparent raincoat, gloves and mask to take work

Anoda sex worker, Antonieta tok say she dey use paper face mask, gloves and raincoat plus even face shield join.

She also tok say she dey spray di pole wey she dey use dace with bleach fo her own brothel.

Di OTN-B bin meet with di health ministry last month to present 30 page manual on how di women dia go fit protect demself as dem dey work.

Dem dey clean bed before and afta use

Wia dis foto come from, Gaston Brito

Wetin we call dis foto, One brothel worker say dem dey clean everywhere regularly to protect customers plus workers dem

Lily Cortes wey dey represent Bolivia sex workers union tok say, all di restrictions wey dey ground dey put di women for danger because if dem enta street with di work hours wey dem get everything go worse pass.

Bolivia don get around 50,000 cases of coronavirus and 1,898 pipo don die with di virus.

Last week, dia presido Jeanine Anez Chavez tweet say she sef don catch di virus.