Lagos-Ibadan train to launch September for Nigeria - See tins to sabi about am plus oda services wey don ready

Outside and inside of di new Lagos - Ibadan train

Wia dis foto come from, Nigerian Railroad Corporation

Wetin we call dis foto, No be plane, na di new train from go do 16 trips between Lagos and Ibadan, starting from Spetember 2020
Read am in 2 mins

Di Nigerian Railway corporation don announce say dem go begin operation for di Lagos-Ibadan line next month.

Transportation na one big problem wey many Nigerians dey face everyday, especially pipo wey dey live for urban cities as road transportation be di only option for most of dem.

Sake of di wahala wey dey di road transportation like long traffic, bad roads and motor accident, many Nigerians bin don dey beg goment to improve di Nigeria railway as dis go reduce di burden for di road.

One of di promise wey dis current administration of Mohammadu Buhari make as dem enta power na to ensure say dem go better railway system - for inter-state travel.

For 2019, di federal goment order for 60 passenger coaches, all of dem don arrive Nigeria and dem don also train engineers wey go dey manage di trains.

Also for 2018, di goment sponsor 45 students from di faculty of engineering for Ahmadu Bello University to go study railway engineering for di Central South University of China (CSU).

Dis na some of di new development wey di railway sector dey carry come for Nigerian commuters.

Lagos - Ibadan

Lagos-Ibadan railway line will grace the newly acquired 24 coaches

Wia dis foto come from, @Official_NRC

According to di Nigerian Railway Corporation (NRC), di agency just buy 24 new coaches for di Lagos - Ibadan railway line.

Di train go dey go 16 trips everyday and e go dey easy for pipo wey dey live for Ibadan to dey come work for Lagos.

Dis operation go start for September 2020, NRC bin tok.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Itakpe - Warri - Ore

ITAKPE - WARRI - ORE RAIL LINE

Wia dis foto come from, @Official_NRC

Di Warri - Itakpe Railway stations according to di Nigeria Railway Corporation don dey ready for commissioning. Dis rail go dey run through Delta, Edo, Kogi and states wey dey near di area.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Marina - Okokomaiko

Lagos Rail

Wia dis foto come from, @Official_NRC

Di Nigerian Railway Corporation don resume work for di Lagos Rail wey go dey move from Marina to Okokomaiko.

Dis rail go ready by June 22 and pipo wey wan use am go fit transport from Marina to Mile 12.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3

Kaduna - Abuja

Di Minister of Transportation Rotimi Amaechi also order 10 more coaches to add o di Kaduna - Abuja route.

Dis new coaches go dey go 14 trips daily from Abuja to Kaduna.