Mafishi: Why Zambia president, students, odas dey mourn di death of dis giant pond fish

Wia dis foto come from, Facebook/Edgar Chagwa Lungu
Zambia dey mourn di death of one giant pond fish for one of di kontri biggest public universities, di Copperbelt University (CBU).
President Edgar Lungu and opposition leader Hakainde Hichilem dey follow mourn di death of di fish wey dem dey call 'Mafishi'.
Mafishi, dey mean "Big Fish" for di local Bemba language, and dem believe say di fish dey about 22 years old and e don live for university pond for more than 20 years, student leader Lawrence Kasonde tok.
Di president of di Copperbelt University Student's Union add say dem don begin investigate di death of 'Mafishi'.
Di fish na part of di university aquaculture initiative.
"We neva bury am, we dey plan to embalm am," Oga Kasonde tell BBC.
For di past two decades CBU students believe say di fish go bring dem good luck for exams.
Students dey pay homage to am before exams for good luck. Oda students consider am stress reliever.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di word Mafishi don dey trend for Twitter for Zambia afta di fish die on Monday night.
President Lungu quote Mahatma Gandhi as im dey mourn di fish, write say "Dem fit judge di greatness of a nation and im moral progress by di way dem dey treat dia animals."
Opposition leader, Oga Hichilema write: "We stand wit di CBU student community, past and present, ontop di death of dia iconic pet Mafishi."
Zambia Higher Education Minister Brian Mushimba also mourn di fish:
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
University students light candles and march around di premises on Monday night to mourn Mafishi:
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2












