New head of house BBNaija 2020: Trikytee na HOH, Laycon deputy, see BBNaija nominations today for Season 5 housemates eviction dis week

Trikytee na di new head of house for Big Brother Naija Season 5 housemates.

Dis na di first time Trikytee dey enta dis role as Head of House since di reality show start on 19 July, 2020.

Trikytee wey real name na Timmy Sinclair win di roll of dice game for di head of house challenge wey di housemates play on Monday.

Im get di highest score for di game to win di title of HOH for di week.

As head of house, Trikytee get automatic protection alias immunity for dis week eviction and exclusive access to di Head of House Lounge.

Im pick Laycon as im deputy head of house and him go enjoy di same privilege wit Trikytee.

See who di Housemates nominate for eviction dis week

Immediately afta di Head of House Challenge, Biggie call all di Housemates to each pick at least two fellow housemates wey dem go like to see leave alias possible eviction from di BBNaija Season 5 show dis weekend:

Wen each of di nine remaining housemates enta di Diary room, dis na how dem nominate.

Trickytee nominate Prince and Kiddwaya

Vee nominate Prince and Dorathy

Prince nominate Ozo and Nengi

Dorathy nominate Kiddwaya and Neo

Laycon nominate Ozo and Dorathy

Kiddwaya nominate Vee and Prince

Neo nominate Prince and Dorathy

Nengi nominate Dorathy and Prince

Ozo nominate Prince and Kiddwaya

Based on di nomination process, di housemates put up Dorathy, Kiddwaya, Ozo and Prince for possible eviction dis week from di lockdown season.

At least one of dem go leave di Big Brother house on Sunday during di live eviction show.

As tin be Trikytee, Laycon, Vee, Neo and Nengi dey safe.

You fit Like dis video: