You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigerian Ministerial review and wetin Buhari tell im ministers as im score dia performance
On dis day, wey mark one year and a week of wen di Ministers of di Federal Republic of Nigeria start dia work on top di second term of di President Muhammadu Buhari administration, dem come togeda to day to tok wetin dem don achieve ova di past one year.
For presidential speech wey vice president Yemi Osinbajo tok e tok say di administration bin help di economy to recover before pandemic, improvement of transport infrastructure, support for agriculture and social investment programmes to empower di youths.
Dem tok say for di event dem go focus on three tins mainly
- Review how everi Minister don perform since 2019: Dis review for delivery on projects wey dem give dem for 2019.
- Wetin make Ministers no achieve some of dia priority mandate; and
- To rework how dem go fit deliver on dia mandate sharp-sharp even wit di way di econmy dey look
For di speech oga Osinbajo also explain wetin cause di rise in di price of fuel.
E tok say for di height of di epidemic for March dem stop to dey regulate di prices of di petroleum products.
Dat means say na di market go dey dey determine di price of di petroleum products.
So, wen di global price bin dey at all time low, na im Nigerians benefit but now wey be say be say di prices of fuel for world don dey adjust na im make fuel for Nigeria add price.
E also add say Nigeria no get di money to dey pay extra alias subsidize fuel prices on top say di goment get 60% less revenue today.
End of Di one wey oda users dey read well well
Tori be say dis new price of 162 Naira still be di lowest for di West and Central African regions.
On di increase in money for electricity, oga Osinbajo, wey represent Buhari for di meeting, tok say dem no fit afford to subsidize di tariff shortfalls if di industry afta dem don spend 1.7 trillion Naira so far to support di industry.
But, di goment through dia regulation bodi NERC don approve make dem make adjustments in pricing of di tarriffs only with beta provision of electricity.
Dis one mean say na only pipo we dey get minimum of 12 hours with light na im dem go fit increase price.
E also tok say even with di pricing change, Nigerian still be one of di cheapest wen you compare am with oda kontris for Africa.