Power Book II: Ghost movie review and three main gist you gatz sabi about dis new movie wey be like continuation of Power

Wia dis foto come from, Getty Images
Na new Ghost don hit di scene afta James St Patrick die for di final season of Power.
Power na crime show wey show di double life of James St Patrick as businessman and drug Kingpin.
But from September, Ghost dey come back but for im pikin Tariq St Patrick.
Dis na three things wey you suppose know about di show.
Who Kill Ghost?
As at now, James wife, Tariq mama dey for prison say na she kill di original Ghost.
However, anoda name don pop out at di end of di first episode of di new spinoff, say na Tommy Egan.
Which kain wahala Tariq don find imself?
Tariq na student of Ivy League University and be basketballer for im school but as im dey try juggle those ones.
E dey also find money wey im go take comot im mama, Tasha out of prison as im dey also take care of im younger sister.
End of Di one wey oda users dey read well well
As if dat one never doo, e dey try build im own empire as di new ghost.

Wia dis foto come from, Instagram/@therealmaryjblige
Wetin Mary J Blige dey find for dia?
Mary J Blige dey start her role for di show as business woman wey dem dey call Monet.
She also na crime boss wey di creator of di show Courtney Kemp say learn how to pla di game for street.
As Tariq dey find di money to free im mama, e go find im self for Monet net.
Na 10 episodes dey season one of Power Book II: Ghost wey just finish.










