Messi: See reasons why di Barcelona legend decide to stay for di club

Wia dis foto come from, Getty Images
Barcelona all-time leading goalscorer Lionel Messi say im go stay for di club because e dey "impossible" for any team to pay im release clause and im no want face di club for court.
Di Argentine, wey be 33 years, bin send fax to Barca last Tuesday to tell dem say im want exercise one clause for im contract wey im say go allow am to leave for free.
But di club say im 700m euro (£624m) release clause dem must meet am.
"I bin think and bin dey sure say I dey free to leave," Messi tell Goal.
"Di president bin always tok say wen season end I fit decide if I want stay or go.
"And dis na di reason why I go stay wit di club. Now I go stay for di club because di president tell me say di only way to leave na to pay di 700m clause, and dat dey impossible."
Messi say di fact say im no tell Barcelona say im want leave di club before 10 June dey critical, and if to say im do am him den di issue of im release clause no go be issue at all.
"Now dem dey hold on to di fact say I no do am before 10 June, when we bin still dey compete for La Liga in di midst of dis coronavirus wahala and di disease affect di season," na wetin im add put.
End of Di one wey oda users dey read well well
" Another way na to go court. I no go ever go court against Barca because na club wey I love, wey give me everything since I arrive.
"Na di club of my life, I make my life here. I know say e never cross my mind to take Barca go court."













