Neymar and Nike don part ways afta 13 years- See why?

Wia dis foto come from, AFP
US sportswear giant, Nike, say dem go end dia thirteen-year relationship wit Brazil football star, Neymar.
For inside statement, di company say di Paris Sant Germain player no go dey dia books afta di end of August.
Brazil media claims say di reason why Nike and Neymar part ways na sake of say di two sides fail to agree on how much money im go collect if im renew im contract.
Dis dey come afta Neymar and im club PSG, lose di Champions League final to Bayern Munich.
Di Brazilian na him hold di record for di most expensive football transfer for history.
French club PSG pay 222 million euros to bring am from Barcelona for 2017.
Many sportswear company go begin bid for Neymar wey be 28 years t, although tori be say Puma don already approach di striker.








